By Tony Ubani
Yeye Tony,
U just dey disappear at will. One time I see you for TV. The next time you dey talk for Radio. But you decided to blackout your favourite Outraged fans. I am outraged with you.
James Robertson, Warri
My broda, na condition bend crafish. It wasn’t intentional. Nobi for nothing make mad men dey waka all street. Em no get control of em brain. For dis job, na so dem dey move me like Soja. Go Abuja, Calabar, Enugu or go Kenya. But, Outraged is here to stay and I apologise for all the time wey una miss una Sunday melecine.
*******************************************
Tonero Coconut head,
Shame to our critics! Na so Bolaji Ojo-Oba scream for una Newspaper after Eagles qualify for World Cup. And I hear Amodu Shaibu dey rant from one corner say em deserve respect from Nigerians and Press. I know say na you em dey refer. But Amodu nobi coach. We all know how Naija dey qualify.
Biodun Adelabu, Lagos [email protected]
Forget Ojo-Oba. Ef he think say dem dey ask plenty question for football, he can move over to Triathlon. Nigerians deserve to know wetin dey happen to dem number one sport. Say Eagles qualify for World no mean say we don forget say $236,000 dollars been develop wings from Glass house. Dem wan sweep am under the carpet with Eagles qualification. But we dey around d corner.
*************************************
Tony Tufiakwa,
God na wise man. See as God allow those old men in small boys shots to play to final in the U-17 World Cup. And wen everybody believe say dem go win the cup, God show why em be God. Ef dem win dat world cup, truth for don die for Nigeria. I hail Adokiye and all those wey stand for the truth.
Ibinabo Jack West, PH
Na only dat one, one Pastor for don take over all the churches in Naija say em dey predict future and results for matches. God don watch with keen interest and say make em check am bifor man take em glory. As for U-17, wen we see dem, we know dem. Nobi old men wey dey use shaving powder dey clear dem whiskers. God have mercy. I even hear say one player bone spoil the MRI machine, naim make FIFA say make dem seize fire.
***********************************
Gud day sir,
What a tension-filled weekend?. Its all over now. Unmerited favour or is sheer luck? The Problem is with the coaching crew. They don’t possess the qualities for the task ahead. Well we are there. The past is now history. The future is what we look up to.
AB, Warri 07055588271
AB, you don talk am finish. We live for world wey people prefer lies to truth. Amodu don qualify Naija instead of make em dey draw salary make better coaches tinker our team dem don begin politics, dey call people like us names. And ef dem make mistake hire foreign coach and leave Amodu for technical crew, yawa go gas. Ef we have to money to pay players for lost or drawn matches, we fit pay technical crew and allow new wine for new bottle. Period!
*********************************************
Tony,
Kenya 2 Nigeria 3. To God be the glory. Now we can start preparation to meet the best 32 teams in the world. Lets find a foreign coach. By the way remember me when hustling for world cup tickets.
Obi Okaro 08022233316
At times, I wonder why God love Naija like em love us. Upon all the bad bad things wey we dey do. Some people go train pass but na we wey cut corners go come triumph. Na thieves wey God dey answer dem prayer pass. I thank God say we qualify but…..
********************************
Send Outraged mails to [email protected] or to 08050498547(sms only. Nobi to ask me to send credit to you o!)
Disclaimer
Comments expressed here do not reflect the opinions of Vanguard newspapers or any employee thereof.